

By Elisha | PulseDaily Gist
Rumour don dey fly for social media say veteran Nollywood actor Zack Orji, popular comedian Seyi Law, and some other celebrities allegedly appear for one street campaign video linked to President Bola Tinubu and di All Progressives Congress (APC).
According to gist wey circulate online, di celebs reportedly dey share biscuits and ₦500 notes to children and bystanders for street.
Social Media Reactions
The gist don cause serious wahala for social media. Some netizens don blast di actors and comedians.
One user write:
“God give Zack Orji second chance, and na so him wan misuse am? See wetin veteran actor reduce himself to.”
Another person add:
“So na biscuit and ₦500 dem take dey campaign? This one don weak me.”
As at di time of this report, neither Zack Orji nor Seyi Law don talk anything about the rumour or confirm whether dem truly appear for the alleged campaign video.
Wetin You Think?
If this rumour na true, una feel say this kind campaign dey okay or e dey somehow? Drop your comment for below make we yarn.
Share this story:
[Facebook] | [X (Twitter)] | [WhatsApp]